[lyrics] Mskill your hand
Verse 1

Oluwa i don send my Aza
I dey wait on you so you go fit run am
All this hustle i been dey hustle make you run am for me
So i go get money to buy my mama house.
Coz i no know as e go take be soon if i never jam this kind money
Oluwa biko i want to dey turn up….x2
Hook 1
I no want after all this hustle wey i dey do
Make e no be say e no go pay o
Just like rain o na so my blessings go be
Make i no go hustle park go village.
Chorus
Oluwa you no go fall my hand
Coz you know say i dey your hand x2
Verse 2
I no say man dey work but na God dey give blessing
Oluwa make you shine your light on me
When God go bless him pikin dem go say the boy don dey jazz up
Oluwa shawa your blessings so the boy go link up
No be must i go kill person
Before i go make am for life
No be must i go do juju before the boy go blow..x2
Hook 2
No be say i no fit do blood money
No be say i no fit carry my neighbour pant
Oluwa na for your hand o wey i dey
Make i no go hustle park go village.
Chorus.
Hook 2
PROMOTION & ADVERTS
For Music Promotion & Adverts Placement on this blog, Kindly Call Or WHATSAPP 📞 (Djwave) +23408100034017 || ( or send us mail: Hypeloadedtv@gmail.com Click Here for more information




